PIDGIN POETRY

PIDGIN POETRY

Eyes wey see evil, wey never blind
For sure, na im go still see better thing
We no die las year, and e sure me die
Say; we no go die dis year
We go live tey for this life

Na awa papa talk am say
“Pikin no dey die for pikin
Las las, im too go commot wings”
The matter be say; e fit last sotay
Dog wey get patience go chop fat bone

Yawa fit dey today
Kasala fit burst tomorrow
Fire fit dey on top the roof
And landlord fit dey sleep for gutter
See this tomorrow, he must better

Wetin man dey see, wey we never see?
Wetin dem dey chop, wey we never chop?
Wetin dem dey drink, wey we never drink?
We do am sotay we get stomach ulcer
And today, the story no be the same

E fit no happen quick quick as we want am
But, we no sey we no be like car wey no get engine
We dey slice am dey go,every day and night
We dey grind, we no dey tire
Make papa God no tey before im come do im own part

© Kolawole Akinrimisi (Masterkay)

Leave a comment